Argentina vs Brazil: Copa America final prediction as Messi and Argentina hope to end 28-year wait10 July 2021, 07:04 WATWia dis foto come from, Getty Images Wetin we call dis foto, Lionel Messi, Neymar JrDi world of football go witness anoda epic final match between archrivals, Brazil and Argentina for di Copa America 2021. Na 10 South American kontris participate for di 47th edition of di Copa America wey dem bin schedule for 2020, but dem postpone am to 2021 sake of di coronavirus outbreak. Argentina reach di final afta dia semi-final win against Colombia for penalty shootout afta dem play 1-1- draw for regulation time. Venue of di Copa America finalNa Brazil dey host di 2021 Copa America Tournament in five venues of Brasília, Goiânia, Cuiabá and Rio de Janeiro. But na for di prestigious Maracaná Stadium for Rio de Janeiro dem go play di final.
Source: BBC July 10, 2021 06:00 UTC